DeGoldBerg - Full Stop (Alright) lyrics

Published

0 132 0

DeGoldBerg - Full Stop (Alright) lyrics

Intro No put fullstop for place wey God just put a comma No go give up for place where God just start with you my brother Yeba! Verse 1 My brother man, na you be this? Wetin happen wey your face be like this? Na because of all the gbogbo ti gbo Join with the kasala you no get money to pay your bills You kill yasef, wetin you gain? Shey the condition go still remain the same? Hypertension and BP worry worry fit kpai man And matter sef e kuku no go change And papa God, He get a plan You get to understand Himself e no be man He no dey fail kpata-kpata as long as you believe wetin Him been dey tell you Everything go dey Him hand No dey fear, make you relax I dey tell you wene mmekpenhi go pass And if you be like say the water don dey pass garri Make you take am easy hear the better advice PRE CHORUS No put Fullstop for place wey God just put a comma No go give up where God just start with you my brother No put Fullstop for place wey God just put a comma No waste your life for nothing Las Las you go dey I say... Chorus Alright (alright). Okay (okay)... "Repeat Chorus" Verse1 Oga madam, ma wetin dey sup Why you be like who the world dey on top Shebi na because of that brother wey don leave you after many many years When he promise say him love But at the end, he break your heart The brother tuwamana just like that But remember say that disappoinment na for reason say the better man dey come in advance No dey fear, stand up on your feet Know that what's gonna be gonna be And believe say na God fit send a better person wey go cherish and love you for who you be For many years, you never born And your mother-in-law don begin dey come She don dey wonder when you go carry your pikin but no worry w no go tay very soon e go be your turn Know your friends number one and number two For your front Dem go ask you "how are you?" You go tell Dem all your story how e happen For your back Dem go use you go dey dance skelewu No dey fear, make you relax I dey tell you wene mmekpenhi go pass And if you be like say the water don dey pass garri Make you take am easy hear the better advice PRE CHORUS No put Fullstop for place wey God just put a comma No go give up where God just start with you my brother No put Fullstop for place wey God just put a comma No waste your life for nothing Las Las you go dey I say... Chorus Alright (alright). Okay (okay)... "Repeat Chorus" Postlude Amaka how you dey (I dey okay...I dey alright) Haruna how you be (I be okay...I be alright) Chibuoso how you dey (I dey okay..I dey alright) No matter how you be, big Bros I tell you Las Las...we go dey alright